Na Fenerbahce demsef take town crier announce am today (Wednesday) dat na £13 million be de money wey dem carry give Spartak Moscow bifor de Russian club kon gree make de Naija man kommot for dia side.
Emenike wey him shot na like bomb go enta de Istanbul club again 2 years afta him kommot bicos of de yawa wey shelle dat time.
Walahi, de kasala no gree allow Emenike tap any ball dat time for Fenerbahce and naso de guy waka go join Spartak Moscow.
Na de Turkish authorities dem been accuse am in May 2011 dat Emenike been no wan jam Fenerbahce dat time wey him dey tap ball for Karabukspor.
Dem tok say Emenike carry lie give him club say him carry wound bifor dem kon later free am say na true him tok dat time.
The kasala no be small thing as de yawa carry Oga presido for Fenerbahce, Aziz Yildirim enta prison for 6 years.
Minwile, Emenike dey among de Eagus wey go face de Bafana Bafana of South Africa for de play play game wey dem go play ness week Wednesday for Durban.
No comments:
Post a Comment